Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 5:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Make una remove di old yist, den una go bi like fresh bread wey nor get yist and dat na wetin una bi. Bikos awa Passova lamb, na Christ wey dem don already sakrifice.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 5:7
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“ ‘For seven days, una must chop bread wey nor get yist. So for di first day, una must remove di yist wey dey una house, bikos if anybody chop bread wey get yist from di first day go rish di sevent day, I go kill-am.


Jesus still tell dem anoda parabol: “God Kingdom bi like yist wey one woman take bake bread. E mix am with plenty flower and di small yist kon make di bread raiz well-well.”


Di day wen dem start di Bread wey nor get yist feast and wey dem dey sakrifice small sheep, Jesus disciples kon ask am, “Where yu wont make wi prepare for yu to chop Passova food?”


Wen day break, John si Jesus dey waka kom meet am, den John sey, “Make una look! Dis na di Sheep wey God send kom die, so dat God go forgive us awa sins.”


Dem kon dey look Jesus wen e dey waka pass, den John kon sey, “Make una look! Na dat pesin bi God Sheep.”


(Dat time na aftanoon for di day wen dem dey prepare for Passova Feast). So, Pilate kon tell di Jew oga dem, “Make una look, na una king bi dis!”


Na God give us Jesus Christ, so dat thru en blood, E go forgive us awa sins wen wi bilive Christ. God do dis to show sey before-before, E dey patient to forgive pipol dia sins.


Bikos wi dey chop from one bread, all of us don bi one body, even doh wi many.


Na God go judge doz wey dey outside, bikos en word sey, “Doz wey dey do wiked tins among una, make una drive dem komot from di church.”


Koncerning di kind life wey una dey live before, wi sey make una trowey dat bad spirit wey dey make una do bad-bad tins


All of dem kon dey sing with loud vois sey: “Di Lamb wey dem kill, make glory, pawa, propaty, wisdom and honor, bi en own!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ