If di priest look am kon si sey di hair wey dey der neva turn white and e nor deep pass di skin, but e get lite kolour, di priest go separate di pesin from oda pipol for seven days.
yu go open dia eyes make dem for waka komot from darkness enter lite. Make dem komot from Satan hand, go meet God, so dat God go forgive dem dia sins and dem go follow di pipol wey God don make klean, bikos dem bilive am.’
about di betta tins wey I si for vishon. Make I for nor dey karry body up, God put sometin inside mi, wey bi Satan messenja, so dat e go dey trobol mi.
Na dis make mi dey rite all dis tins since I nor dey with una, so dat wen I kom, I nor go vex for una bikos of di authority wey I get and God give mi dis authority to build; nor bi to distroy.
Since wi dey wait for di day wey Christ go kom, make wi dey do wetin wi fit do to make Christ kwik kom. Bikos for dat day, evritin wey dey for heaven go burn kon skata and di stars, go melt.
If anybody si en broda or sista for Christ dey kommit sin wey nor go kill-am, make e ask God and God go give life to dat pesin. E get di kind sin wey dey kause deat and I nor sey make una pray make God forgive di pesin wey dey kommit dat kind sin.