Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 4:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 My mind dey klear, but dat nor mean sey I dey innocent. Na only God go fit judge mi.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 4:4
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Any human being fit dey klean? Anybody fit dey rite before God?


Anybody fit dey klean before God? How yu wey woman born won take dey pure?


I nor go ever give up, bikos I dey rite; my mind dey klean and my konscience nor dey judge mi.


“True-true, I dey tok like fool since, wetin I go fit ansa? I nor go try tok anytin again.


I know sey I nor do any bad tin, but my mout fit kondemn mi. Even doh I dey innocent, my mout go still fit put mi for wahala.


If to sey Yu, my God won kount all di sins wey pesin kommit, den na who go fit stand before Yu?


Make Yu nor judge mi yor savant, bikos evribody dey guilty for yor front.


So God, how I won take know all my fault? Make Yu klean mi from di bad tins wey I do wey I nor know.


Naw, I dey save and I don join di pipol wey dey woship Yu, so I go praiz my God.


Make di heaven tok about how E take dey judge bikos na God go judge by ensef. Make di heavens tok about en good judgement, bikos na God bi di judge.


Pesin fit tink sey evritin wey e dey do dey korrect, but remember sey God dey judge evritin wey wi dey do.


Evribody wont make king favor dem, but na only God dey give korrect judgement.


Jesus ask am di third time, “Simon, John pikin, yu sure sey yu love mi so?” Pita kon dey vex, bikos e pain am well-well, as Jesus ask am di same kweshon three times, “Yu sure sey yu love mi so?” Den Pita sey, “Oga God, yu know evritin, yu know sey I really love yu.” So, Jesus tell am, “Make yu feed my sheep.


Paul look di kansol pipol kon tell dem, “My brodas, I dey live my life with klean mind for God eye kon rish today.”


Bikos yu dey hear di law nor mean sey yu good for God eye, but na wen yu do wetin di law tok.


If na di good tins wey e do make am dey good for God eye, den e suppose to dey boast for pipol, but e nor go ever fit boast for God.


So, e nor koncern mi if yu or any human kourt dey judge mi. Even mi nor fit judge mysef.


So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.


Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.


Bikos all of us must stand for Christ front and e go judge us akordin to di tins wey wi do wen wi dey dis eart; weda dem good or bad.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ