3 So, e nor koncern mi if yu or any human kourt dey judge mi. Even mi nor fit judge mysef.
Make una nor dey judge pesin, bikos of wetin una si with una eye, but make una give korrect judgement as e suppose to bi.”
Pesin wey dey listin to di Spirit fit judge oda pipol, but nobody go fit judge dem:
make e know sey, God go espose en work, bikos E go test am with fire for Judgement Day. Di fire go test di work wey evribody dey do.
God wont make wi dey faithful to am.
My mind dey klear, but dat nor mean sey I dey innocent. Na only God go fit judge mi.
But God tell Samuel, “Make yu nor happy, bikos of how en face look, bikos nor bi en I choose. God nor dey si tins di way una dey si am. Pipol dey look pipol from how dem bi for outside, but God dey look pipol from how dem bi for dia heart.”