But if anybody really dey hongry, make e chop kom from en house. Den wen una dey togeda, una nor go kondemn unasef. So wen I kom, I go tell una oda tins wey una suppose know.
I for like make all of una dey tok with difren language, but I wont make una dey profesai. Bikos profesy go do una more good, dan sey una dey tok with difren language wey pipol nor fit undastand, unless somebody esplain di meaning give di pipol for di church.
My friends, I don use mysef and Apollos as ezample for una, so dat thru us, una go know wetin e mean to obey di law. I nor wont make una dey sey one of us betta pass di oda pesin.