Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 4:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Bikos even if 10,000 pipol kon tish una about Christ, na only one papa una go still get. Bikos una don turn to my pikin, wen una receive di message about Christ from mi.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 4:15
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Nor bi mi kreate or born dem o-o! Why Yu go tell mi sey make I kare and karry dem for my hand like sey dem bi small pikin? Na so I go take karry dem go rish di land wey Yu promise dia grand-grand papa?


But I like to prish di Good News for where pipol nor know Christ, so dat I nor go build house on-top anoda man foundashon,


Una don bi Christ friends bikos of God and na thru Christ wi get wisdom, goodness and holiness wey kom from God;


My brodas and sistas, I wont make una remember di gospel wey I prish give una,


Na God grace make mi sabi build well-well. I lay foundashon wey anoda pesin build put. But make wi take kare as wi dey build,


I dey plant di seed and Apollos dey wota dem, but na God dey make di seed grow.


Di pesin wey plant di seed and di one wey wota am, na di same work dem dey do, but each pesin go get en pay from God akordin to en work.


If odas dey do like dis, dat mean sey wi even get betta rite to do like dat too. But, wi dey bear evritin, so dat wi nor go kause trobol for Christ message.


Na so too God kommand sey, doz wey dey prish di gospel, go chop thru di gospel wey dem dey prish.


Bikos if I dey prish di gospel, I nor get any rizin to boast, bikos I nor fit do any oda tin dan to dey prish di gospel! Na wahala for mi, if I nor prish di gospel!


Wetin kon bi my gain? Na to prish di gospel without pay or na to use di rite wey I get, bikos I dey prish di gospel?


Na di gospel make mi dey do all dis tins, so dat I go fit share for di blessings.


Wi nor dey tok about awasef, but wi dey prish sey, na Jesus Christ bi Oga God and wi bi una slave, bikos of am.


So na di law bi awa tisha before Christ kom, so dat wi go fit tok sey wi dey raitious thru faith.


But since faith don kom, wi nor dey under any tisha again.


My shidren! Just like woman wey won born, I dey feel pain for una, until Christ pawa go dey inside una life!


Bikos time dey kom wen pipol nor go won hear good and betta tishing again. Instead, dem go dey follow wetin dey hongry dem to do kon dey find tisha wey go tish dem wetin dem won hear.


I dey rite to Titus, my own pikin for faith. Make grace and peace wey dey kom from God awa Papa and from awa Savior Jesus Christ, dey with yu.


Na mi Paul take my hand rite dis leta sey, I go pay back, but I fit still sey, yu yorsef dey whole mi.


As God wont am, E kon born us with di true message, so dat wi go bi first among all wetin E kreate.


God nor save una with human being body wey fit die, but na thru en word wey get life and dey forever.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ