Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 4:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 I nor dey rite dis tins make una for shame, but na to korrect una as shidren wey I love.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 4:14
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But if yu warn am make e nor sin, e go get life and yu yorsef go dey save from my vexnashon.”


So make una shine una eye and remember sey, for day and nite for three years, I nor stop to dey kry, as I dey warn una.


Make una get sense and stop to dey kommit sin. I still dey sopraiz sey some pipol among una nor know God.


Bikos even if 10,000 pipol kon tish una about Christ, na only one papa una go still get. Bikos una don turn to my pikin, wen una receive di message about Christ from mi.


Na to enkourage una make mi send Timoti, my son wey I like and wey love Christ kom meet una. E go tell una how I dey follow Christ and di tins wey I dey prish about Christ for evry church.


I dey tok like dis, so dat una go shame! So una nor get wise pesin among una wey fit judge between una wey bi Christians?


But I nor dey use all dis rite and I nor dey rite dis tins so dat pesin go give mi sometin. E betta make I die, dan make anybody kon make mi stop to dey tok like dis.


Why? Na bikos I nor love una? No! God know sey I love una!


May bi una dey tink sey wi dey tok dis tins to defend awasef. No! Wi dey tok to una like dis as Christ savant and na God bi awa witness. Evritin wey wi dey do, na to make una strong.


I nor dey tok dis one to kondemn una, bikos I don tell una before sey, una dey awa mind and wi with una go die and live togeda with Christ.


As wi dey tell evribody wetin dem go do, wi dey prish Christ and tish with wisdom, so dat wen wi go show una to Christ, una go don dey pafet.


As unasef know, wi dey trit una as papa dey trit en shidren.


Wi dey beg una, awa brodas and sistas, make una tell pipol wey dey bihave anyhow sey, wetin dem dey do nor good, den make una help doz wey dey weak, but make una dey patient with evribody.


But if anybody nor obey awa message thru dis leta, make una look dat kind pesin well-well and make nobody follow am waka or do anytin togeda, so dat shame go katch am.


Abeg, make yu dey kind to Onesimus, wey bi my pikin for God work and e dey prison with mi.


(My shidren, I dey rite about dis matter, so dat una nor go dey sin.) But if anybody sin, wi get pesin wey dey beg di Papa for us, dat pesin, na Jesus Christ wey dey raitious


Wetin make mi happy well-well na wen I hear sey my shidren dey live akordin to di trut.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ