Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 3:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 I dey plant di seed and Apollos dey wota dem, but na God dey make di seed grow.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 3:6
29 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Unless God build house, di pipol wey dey build am, just dey waste dia time. Unless God guide town, doz wey dey guide am, nor go fit protet am.


God don tok many times sey, “All di pawa for heaven and eart, dey my hand


Human being bi like ordinary dirty wey breeze dey blow and pipol wey feel sey dem strong, nor get pawa at-all. If yu go measure dem for skale, all of dem togeda nor heavy rish air.


Make yu dey give and yu go prosper; help odas and yu go get help.


Just as seed dey take grow, na so God wey bi king, go take save en pipol and all di nashons go praiz am.


Wen dem hear wetin Pita tok, dem nor argue with am again, so dem kon start to praiz God. Den dem sey, “Naim bi sey God don give Gentile pipol di shance to take turn from sin kom meet am, so dat dem go get di life wey nor dey end.”


Wen dem rish Antiok, dem gada di pipol kon tell dem all di tins wey God use dem do and how E open road for Gentile pipol to bilive.


E get one woman wey dey listin to us, en name na Lydia and e kom from Tiatira. E dey fear God well-well and dey sell purpol klot. God open en heart to bilive evritin wey Paul tok.


E get one Jew man, en name na Apollos and e from Alexandria go Efesus. Apollos sabi tok and e know di Bible well-well.


For di same time wen Apollos dey Korint, Paul travel pass inside town until e rish Efesus. For der, e meet some disciples


Wen Paul don greet dem, e kon start to tok di story about wetin God don do for Gentile pipol thru en ministry.


With betta mind, evritin wey I dey tok about, na how Christ let mi tok and work, so dat Gentile pipol go obey am.


Wetin I hear bi sey, some of una dey sey, “Na Paul side I dey” odas sey, “Na Apollos side I dey” some still sey, “Na Pita side I dey” or “Na Christ side I dey.”


Una don bi Christ friends bikos of God and na thru Christ wi get wisdom, goodness and holiness wey kom from God;


Paul, Apollos, Pita, di world, life or deat; tins wey dey naw or tins wey go dey tumoro, all of dem na una own.


Pesin wey plant and di one wey wota, nor mean anytin, bikos na God dey make di seed grow.


I nor dey free? I nor bi apostle? Abi I neva si awa Oga God Jesus? Nor bi una dey show di work wey I don do?


So dat Christ go dey inside una heart thru faith and wen una don strong well-well inside God love,


Nor bi only thru ordinary word wi take prish di gospel give una, but na with di Holy Spirit pawa and wi show sey, evritin wey e tok, na true. Una know how wi dey live and help una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ