Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 3:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 bikos una neva get di Spirit since jealousy and kworel still dey among una. Dis mean sey una neva get di Spirit and una still dey live like pipol wey dey di world.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 3:3
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But just like Adam, my pipol sef break di kovenant wey I make with dem.


So make wi dey bihave well as pipol dey do for day time. Nor go anyhow party or drink too mush, den kon dey bihave anyhow. Nor kworel or judge pipol.


My brodas and sistas, I dey beg una with awa Oga God Jesus Christ name sey, make una nor kworel, but make una get one mind for evritin wey una dey do.


Bikos I don hear thru Khloe family sey, una dey kworel among unasef.


Bikos I hear sey wen una gada dey woship God for church, na so-so kworel una dey kworel and I bilive sey some for wetin I hear, na true.


Some of una dey sey, “Na Paul I dey follow,” odas sey, “Na Apollos bi awa leader.” Na pipol wey nor know God dey do like dat!


Bikos I dey fear sey wen I kom, I nor go like wetin I go si and una nor go like as I go tok. I dey fear sey una go dey kworel, dey jealous each oda; dey vex; dey tink of only unasef; dey tok bad about each oda; dey do aproko; dey karry body up and dey bihave anyhow.


But if una kontinue to kworel among unasef; una go fit wound or kill each oda by mistake.


Before naw, wi dey bihave like fool; wi nor dey obey; wi dey deceive pipol; wi bi savant to tins wey dey sweet us; wi dey do bad tins and dey jealous odas; pipol hate us and wi hate dem too.


Bikos where jealousy and long-trot dey, wahala and bad tins wey pipol dey do, dey der too.


bikos e don do wetin God wont and nor bi wetin pipol wont.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ