14 God go reward us if di fire nor burn wetin wi build.
But wise pipol go shine like lite for di sky. Doz wey tish pipol di rite tin, go shine like star forever and ever.
Di pesin wey plant di seed and di one wey wota am, na di same work dem dey do, but each pesin go get en pay from God akordin to en work.
So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.
If I prish bikos I wont prish, dem go pay mi, but even if I nor wont prish, di prishin na wetin God send mi kom do.
Instead of una to dey kompare unasef with anoda pesin, make una shek unasef, den una go fit tok about unasef.
Nor bi una bi awa hope, joy and crown wey wi go take boast give Jesus wen E kom? Yes! Na una!
I don fight di good fight for di faith wey I get; I don run di race finish; I don do wetin I promise sey I go do.
Mi wey bi una fellow elder, wey si how Christ sofa and go share for God glory wey go soon kom, dey beg di eldas among una sey:
So wen di big shepad, Jesus Christ go kom, e go give una crown wey en glory nor go ever fade.