Na justice dem go take measure di foundashon. And na trut dem go take build am.” Big-big stones go fall kon kill all di pipol wey dey lie well-well and wota go distroy all di place where dem tink sey dem dey save.
Den make una remember God kommand and evritin wey di profets sey go happen. True-true, all di pipol wey dey si vishon, dey tok all dis tins, bikos dia mind dey dark.
I go test di third part wey survive kon klean dem, just as dem dey klean silva for fire. I go test dem, just as dem dey test gold. Den dem go pray give mi and I go ansa dem. I go tell dem sey dem bi my pipol and dem go sey, ‘Na di Oga bi awa God.’ ”
Oga God sey, “Dem go bi my pipol. For di day wey I go kom judge di world, na dem go bi my own. I go sorry for dem, just as papa dey sorry for en pikin wey serve am.
But who go fit bear di day wen E go kom? Who go fit survive wen E go appear? Bikos E go bi like strong soap wey dey spoil klot and like fire wey dey melt iron.
But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins.
So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.
And naim make mi dey sofa wetin I dey sofa so. But I nor dey shame, bikos I know di Pesin wey I dey serve and I dey sure sey, E go guide di tin wey I gi-am whole, until di day wey Christ go kom.
Naw, di prize for raitiousness dey wait mi and na God wey dey judge rite go give mi dis prize for di day wen Christ go kom. Di prize nor bi for mi alone, but na for evribody wey dey wait for Christ to kom back.
Make wi nor stop to dey meet and fellowship togeda, as some pipol dey do, but make wi enkourage one anoda more-more, since wi know sey, “Di Day wen Christ go kom,” don near.
Dis kind sofa go show sey una faith na really one. Gold wey go spoil one day, dem still dey test am for fire, tok-less of una faith wey get value pass gold and e go bring praiz, glory and honor wen Jesus Christ go kom.
Di day wen God go kom, go bi like wen tif dey kom for nite. Wen E kom, di heaven go disappear with loud nois and di stars for up go melt, di whole eart and evritin wey dey inside, go vanish.
Na di same word God take keep dis heaven and eart dey wait for fire wey go kom. E keep dem dey wait Judgement day. Di day wen E go distroy di pipol wey nor dey fear am.
And I si di pipol wey don die, both big and small, as dem stand for di throne front. Dem open plenty books and den kon open anoda book wey bi di Life Book. And dem judge doz wey don die akordin to wetin dem rite for di books sey dem do.