Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 3:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 So if anybody use gold, silva, fine stones, wood, or difren grass take build on-top dis foundashon,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 3:12
33 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yor kommand dey good to mi pass plenty silva and gold.


Dem betta pass silva and even gold wey fine well-well. Dem sweet pass honey; even di honey wey dey fall from bee house.


So di pipol kon bigin waka for inside Egypt dey find wetin dem take dey make block.


E betta well-well to get wisdom and undastandin, dan to get gold and silva.


Make yu nor add join God word, if not, E go curse and koll yu lie-lie pesin.


Instead of silva, make una take my words; make una choose wisdom, instead of di gold wey fine pass.


Instead of bronze, I go give una gold. I go give una silva and bronze, instead of iron and wood; den I go still give una iron, instead of stone. Una rulers nor go opress una again and I go make dem rule with betta judgement and peace.


Make di profet wey dream, tok only wetin e dream and make di profet wey hear my message, tok di trut. Nobody fit use tree kanda kompare di main tree.


Even among una, some men go stand dey tish lie-lie tins kon draw pipol follow body.


Naw, my brodas and sistas, I dey beg una, make una know di pipol wey dey kause wahala and oppoz di tishing wey una don learn from us. Den make una nor go near dem!


bikos God don choose Jesus Christ as di One and only foundashon and dem nor go fit lay any oda foundashon.


make e know sey, God go espose en work, bikos E go test am with fire for Judgement Day. Di fire go test di work wey evribody dey do.


Wi nor bi like odas wey dey do God word like sey na sometin wey dem fit sell; but bikos na God send us kom, wi dey tok di trut for en present, as Christ savant.


But wi don stop to dey do wiked tins wey pipol dey hide dey do; wi nor dey do wayo or lie join God word, but with trut wey evribody fit si, wi dey make evribody know for dia mind sey, wetin wi dey do, dey good for God eye.


Make una take kare and nor let anybody fool una with wayo tok about human being wisdom and spiritual pawas wey dey rule di world, but make una dey do as Christ wont.


If anybody dey tish wetin nor korrect and nor gri with awa Oga God Jesus Christ tishing and as God wont make wi dey live awa life,


Wen yu go rish man house, nor bi only gold and silva tins dey der, but tins wey dem use wood and klay take make still dey der too and some dey make di house fine and odas nor good at-all.


But wiked and evil pipol nor go prosper. Dem go deceive odas and dem go deceive diasef too.


Doz kind wimen dey try to learn, but dem nor dey fit know di trut.


Bikos time dey kom wen pipol nor go won hear good and betta tishing again. Instead, dem go dey follow wetin dey hongry dem to do kon dey find tisha wey go tish dem wetin dem won hear.


Make una nor let difren-difren prishin wey una nor know turn una head. Una spiritual pawa dey kom from God grace, nor bi from food wey dem sakrifice, bikos di sakrifice nor fit help pipol wey dey do am.


Dis kind sofa go show sey una faith na really one. Gold wey go spoil one day, dem still dey test am for fire, tok-less of una faith wey get value pass gold and e go bring praiz, glory and honor wen Jesus Christ go kom.


But dis na wetin I get against yu: yu get some pipol wey dey follow wetin Balaam dey tish and na Balaam tell Balak sey make e curse wahala for Israel pipol. Na-im make dem sin wen e sey make dem chop juju food kon sleep with who nor bi dia husband or wife.


Na jasper dem take make di town wall and na pure gold wey klear like glass, dem take make di town ensef.


So I advise yu sey make yu buy gold; gold wey dem don polish with fire. Den yu go get plenty money. Make yu still buy white klot from mi kon wear am, so dat dem nor go si yor nakednes again, den buy medicine put for yor eye, so dat yu go fit si.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ