11 bikos God don choose Jesus Christ as di One and only foundashon and dem nor go fit lay any oda foundashon.
Naw, dis na wetin God tok, “I dey put one foundashon stone for Zion and dem rite dis word put, ‘Di pesin wey bilive and get faith, make e nor fear.’
And I tell yu, yu bi Pita, wey mean rock and on-top dis rock, I go build my church and di gate for hell nor go fit skata am.
Na God grace make mi sabi build well-well. I lay foundashon wey anoda pesin build put. But make wi take kare as wi dey build,
So if anybody use gold, silva, fine stones, wood, or difren grass take build on-top dis foundashon,
Dis na bikos, God don build una on-top di apostles and profets foundashon and na Jesus Christ bi di nomba one stone wey God take lay di foundashon.
But God strong foundashon still stand and dem rite put sey, “God know en pipol and evribody wey bi Christ own, must stop to do evil.”
Una don kom meet Christ, wey bi di stone wey dey alive. Pipol rijet am, but God choose am and e dey important for God eye.