Hiram still sey, “Na di Oga God for Israel deserve all di praiz, bikos na-im make di sky and di eart! E don give David one pikin wey wise and undastand sey e suppose build temple for God, plus royal palis for ensef.
Jesus ansa, “Make una shine una eye, so dat nobody go deceive una. Bikos many pipol go kom prish with my name sey, ‘Na mi bi Jesus’ or ‘Di time don near.’ Make una nor follow dem!
Wen Apollos one cross go Akaia, di brodas enkourage am kon gi-am leta make e give di disciples, so dat dem go welkom am. Wen e rish der, e kon join dey help di bilivers,
By di grace wey God give mi, I dey tell all of una, make una nor tink sey una too dey important. Instead, make una use good sense tink and undastand di faith wey God give una.
Wi nor dey boast anyhow about di work wey oda pipol do, but wi dey hope sey as una faith dey grow well-well, awa work among una go big, just as God share am give us,
Make yu wosh as yu dey live yor life and di tins wey yu dey tish. Get patient, bikos if yu dey do like dis, yu go save yorsef and doz wey dey listin to yu.
Make yu do evritin wey yu fit do, so dat God go si yu as betta pesin. Dey do yor work well as pesin wey nor dey shame, but dey ready to esplain God word wey bi trut.
Pesin wey dey prish; make e prish God word well. Pesin wey dey help odas, make e do am with di pawa wey God gi-am, so dat for evritin, God go get glory thru Jesus Christ. Make all glory and pawa bi Christ own forever and ever. Amen!