Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 2:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Evry word wey wi dey tok, na God Spirit tish us and nor bi human wisdom. Na dis same Spirit dey help us tish spiritual tins to pipol wey get God Spirit.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 2:13
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

bikos di Holy Spirit go tell una wetin to tok, wen dat time rish.”


Den di Holy Spirit enter dia body and as di Spirit give dem pawa, dem kon start to tok for difren language.


Bikos Christ nor send mi go baptize, but na to prish di gospel and nor bi with ordinary wisdom wey go make di sofa wey Christ sofa for cross, yeye.


Bikos if una dey tok with difren-difren language wey odas nor undastand, God go undastand wetin una dey tok, aldo know oda pesin go know wetin e mean. Tins wey una go dey tok about, na only di Spirit go fit undastand dem.


My brodas and sistas, wen I kom tell una about God word, I nor tok to una with big-big word or try to show sey I get sense.


So, na only who get God Spirit fit undastand spiritual blessings. Pesin wey nor get God Spirit, nor go fit undastand wetin di Spirit dey tok.


Wen I dey tok and prish to una, I nor try to show sey I get sense, but I dey do evritin with God pawa wey di Holy Spirit dey give,


So if wi don plant spiritual seed among una, e go dey too mush if wi ask for ordinary food and drink from una?


Make una dey tok to unasef with psalms, hymns and spiritual songs. For inside una heart, make una dey praiz God with hymns and psalms.


Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart.


Dem show sey nor bi demsef dem dey work for, but na for una, bikos una hear dis matter from di apostles thru di Holy Spirit pawa wey kom from heaven. Even angels dey wish sey dem know dis tins.


Bikos, wi nor use awa brain take tell una lie-lie story about Christ pawa and how E go kom back.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ