3 Wen I kom, I go send pipol wey una choose kon give dem leta as dem dey karry una gifts go Jerusalem.
But if anybody really dey hongry, make e chop kom from en house. Den wen una dey togeda, una nor go kondemn unasef. So wen I kom, I go tell una oda tins wey una suppose know.
But if una sey make I go too, den, dem go follow mi go.
Wi don dey boast about awasef again? Wi nor nid una to rite sey, wi dey good, even doh odas dey wont am like dat!
and dem dey beg us make wi let dem do am, so dat dem go get di blessing wey dey follow pipol wey dey give.
Na dis make us beg Titus sey, as e don start, e good make e finish dis good work wey e dey do, bikos e love una.