My love, make yu tell mi! Na where yu won go feed yor animals today? Where yor sheep dem go for rest dis aftanoon? Make yu tell mi, if not I go dey waka up-and-down like ashawo for where yor friends and dia animals dey!
If to sey dem nor si di mirakle wey I do, wey nobody don do before, dem for nor dey guilty for dia sin. But afta dem don si di mirakles, dem still hate mi and my Papa.
God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.