20 All di brodas sey make I greet una.
If una dey greet only una brodas, una nor betta pass odas, bikos pipol wey nor know God still dey do like dat, abi nor bi so?
Make una salot one anoda with kiss for jaw. All di church wey bi Christ own, dey greet una.
Timoti, my ko-worker; Lucius, Jason and Sosipater my kountry man, all of dem dey greet una.
Gaius, wey dey kare for mi and di church, dey greet una. Erastus wey bi di town treasurer and awa broda Kwartus, dey greet una.
God pipol wey dey here dey greet una too, especially doz ones wey kom from Caesar house.
Make una greet all di brodas and sistas as God wont am.
Make una greet all una leaders and all God pipol. God pipol for Italy dey greet una.
Make una salot each oda with Jesus Christ love. Make peace dey with all of una wey dey inside Christ.