18 and dem don let belle sweet mi, just as dem make belle sweet una. E good make wi dey tok about pipol like dem.
As kold wota dey sweet for dry sizin, na so too savant wey pesin fit trust, dey make belle sweet di pesin wey send am.
To hear good news from land wey far, bi like wen pesin pour kold wota or drink for en body.
Make una pray give God, so dat I go kom visit una with happiness.
So, Christ don make awa mind strong. Even as awa heart don strong rish, wi dey happy more-more for Titus wey kom, bikos all of una don let en mind rest.
Na bikos of dis I send am kom meet una, so dat una go know how tins bi for us and make e for give una heart.
Naw wi dey beg una, awa brodas and sistas, make una dey respet doz wey dey work, guide and tell una wetin to do about dis matter wey koncern Christ.
So my broda, make yu do dis tin for mi bikos of Christ, so dat belle go sweet mi.
I get joy and my heart dey strong bikos of yor love and thru yu, all God pipol heart don strong too.
Make una remember una leaders wey tish una God word; make una tink about di kind life wey dem dey live, den make una follow dia faith.
Wetin make mi happy well-well na wen I hear sey my shidren dey live akordin to di trut.