Den one spirit enter Amasai wey dey lead Di Thirty, so e kon sey, “David, Jesse pikin, wi dey yor side! E go betta for yu! E go betta for doz wey dey help yu! True-true, yor God dey yor side!” So David welkom dem kon make dem ofisas among en sojas.
So for di church, God first choose apostles, before profets and tishas. E still choose some wey dey do mirakle, odas wey dey heal sick pipol, some wey bi leaders and odas wey dey tok with difren-difren language.
Yes, my good friends, I still dey tell una, make una help dem. Dem try as dem dey prish di gospel with mi, both Klement and my oda ko-workers, wey dia name dey inside Christ Life Book.
But awa brodas and sistas, wi hope sey una remember as wi dey work for both day and nite, so dat as wi dey prish di gospel, wi nor go bi problem to una.
Make una obey una leaders and do evritin wey dem tok, bikos na dem dey kare for una soul and dem go ansa God wen E ask dem how dem do dia work. Make una let dem do am with happiness, nor bi with komplain, bikos una nor go get any betta tin from am.
God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.
For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.