Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 16:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 For evritin wey una dey do, make una dey show love.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 16:14
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wetin I dey tell una bi sey, ‘Make una love each oda.’ ”


Bikos if di food wey yu chop make yor broda or sista vex for yu, den yu nor dey show love again. So make yu nor let di kind food wey yu dey chop, offend di pesin wey Jesus Christ die for.


But I wont make una ask for di gift wey betta pass, so dat I go show una di way wey betta pass all dis tins.


Na love suppose guide una. So make una dey fight to get di gift wey di Holy Spirit dey give, especially di gift to profesai.


Una know sey na Stefanas and en family first bilive God for Akaia. Dem don do evritin wey dem fit do for God pipol. My friends, I wont make una


For di leta wey una rite, una ask mi about juju food. And all of us know sometin koncerning dis matter. But if wetin wi know, dey make us dey proud, den bikos of love, wi suppose help one anoda.


But di fruit wey di Holy Spirit dey bear inside us; na love, joy, peace, patient, kindness, goodness, faithfulnes,


Make Christ make una love for each oda and for evribody, grow more-more and big, just as awa love for una bi,


But naw, Timoti don kom meet us afta e si una and e tell us di Good News about di faith and love wey una get. E still tell us sey, una dey always remember and dey hongry to si us, just as wi dey hongry to si una.


Wi get betta rizin to dey tank God evritime for una, bikos una faith dey grow more-more and di love wey una get for each oda, dey grow too.


But di rizin why I dey give dis kommand, na bikos I love dem from my heart with betta mind and faith.


Make evribody respet marriage: una must make sure sey una nor sleep with who nor bi una husband or wife, bikos God go judge pipol wey dey sleep with who dem nor marry and pipol wey don marry, wey dey sleep with oda pipol.


As una dey do so, make una love for each oda dey strong, bikos love dey kover plenty sins.


and love una brodas and sistas without parsha.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ