So di church send dem go and as dem dey go, dem pass Foenicia and Samaria kon tell pipol wey dem meet for der how Gentile pipol take turn from dia sin kom meet God and di story make all di brodas wey hear am, happy well-well.
Dem don even tok about yor love for inside di church where God pipol gada. E go good sey wen dem kom yor side, make yu help dem, so dat belle go sweet God as dem dey kontinue dia journey.