One among dem wey en name bi Agabus, get up and di Holy Spirit kon put word for en mout sey, “Heavy honga go happen for di whole world.” Dis tin happen di time wen Klaudius dey rule.
But if anybody really dey hongry, make e chop kom from en house. Den wen una dey togeda, una nor go kondemn unasef. So wen I kom, I go tell una oda tins wey una suppose know.
Na to enkourage una make mi send Timoti, my son wey I like and wey love Christ kom meet una. E go tell una how I dey follow Christ and di tins wey I dey prish about Christ for evry church.
God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.