1 Korintians 15:58 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
58 So my friends, make una dey strong and nor let anytin shake una. Make una always dey do God work, bikos una know sey, evritin wey una do for God, get gain.
So, as God don promise us all dis tins, make wi wosh awasef komot from evritin wey go fit make awa body or awa soul dirty, so dat wi go dey holy as wi dey respet God.
If true-true una get faith and una leg strong for groun, den una go get hope kon whole di gospel wey una hear. Dem don prish dis gospel give evribody for di world and mi Paul don bi di gospel savant.
So wen I nor fit bear again, I send pesin make e help mi shek how una faith bi, bikos I dey fear sey devil wey dey tempt pipol, don tempt una and all di work wey wi do among una, don dey yuzles.
Finally, my brodas and sistas, wi dey ask and beg una bikos of Christ sey, as una don hear from us about how una suppose live as God wont (as una dey do naw), make una kontinue to dey live like dat.
make E give una evritin wey una nid to do wetin E wont. Anytin wey good for en eye, make E do am inside us thru Jesus Christ. Make all glory bi Jesus Christ own forever and ever. Amen!
God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.
So, my friends, as una dey wait for dis tins, make una do wetin una fit do, so dat una go get peace and una go dey without stain or fault wen una go enter en kingdom.