Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 15:50 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

50 My friends, I wont make una know sey awa body wey get blood go rotin. Dat mean sey dis kind body, nor go fit enter God kingdom wey go dey forever.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 15:50
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Jesus tell am, “God go bless yu, Simon, Jonah pikin, bikos na my Papa for heaven show yu dis tin, nor bi human being.


“Den di king go tell di pipol wey dey en rite hand, ‘Make una kom, una wey my Papa don bless and make una inherit di kingdom wey God prepare for una before di world start.


God go give life wey nor dey end to di pipol wey dey do good, wey wont glory, honor and long life.


Wetin I hear bi sey, some of una dey sey, “Na Paul side I dey” odas sey, “Na Apollos side I dey” some still sey, “Na Pita side I dey” or “Na Christ side I dey.”


Na so e go bi afta wi don raiz-up from deat. Dis body wey wi get naw, go die, but di body wey wi go take raiz from deat, go dey forever.


As Fisical body dey, na so too spiritual body dey. And awa Fisical body go shange to spiritual body.


tif; long-trot; drunkard; doz wey dey curse pipol and doz wey dey play wayo; non of dem go enter God kingdom.


Una still dey sey, “Food dey good for awa body and awa body nid food.” But I dey tell una, “God go distroy di two of dem.” So make wi nor use awa body take do yeye tins.


Una nor know sey wiked pipol nor go enter God kingdom? So make una nor fool unasef! Pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey serve juju; men wey dey sleep with oda men;


My friends, wetin I mean bi sey Christ go soon kom and e nor matter if yu don marry or not.


Wi know sey if dis awa house for eart, wey bi awa body skata, God get di one wey wi go stay, wey e bi sey nor bi human being hand build am and e go last forever for heaven.


Na wetin I dey tok bi dis; Pesin wey plant small, go harvest small, but di pesin wey plant plenty, go harvest plenty.


Na wetin I dey tok bi dis: Di law wey kom afta four hundred and thirty years, nor get pawa to break di agriment and promise wey God and Abraham don make before.


I tell una, make una let di Spirit direct una life and una nor go do wetin di flesh wont.


So, I dey use Christ pawa take tell una dis tins sey, make una nor live una life like Gentile pipol wey dey tink only bad and tins wey nor get sense.


I dey tok all dis tins, so dat nobody go dey deceive una with argument.


And Christ go still save mi from evry evil plan until e take mi enter en kingdom. Make glory bi en own forever and ever. Amen!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ