49 Just as wi bi like di first man wey kom from eart, wi go bi like di sekond man wey kom from heaven.
Wen Adam don old rish hundred and thirty years, e kon get one pikin wey bi like am and en name na Seth.
Den, God pipol go shine like sun inside dia Papa Kingdom. Anybody wey get ear, make e hear!
God know doz wey E don choose, so E don make dem bi like en Pikin, so dat en pikin go bi di first-born.
All of us wey don bilive Christ, God glory dey show for awa face. So di Spirit dey help us shange, so dat wi go bi like Christ.
E go use en pawa wey make am Oga God for evritin, take shange dis awa ordinary body and awa body go kon bi like en own wey get glory.
My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi.