Just as yu nor go fit undastand how breeze dey blow or how pikin take dey grow for en mama belle, na so too yu nor go fit undastand how God take make evritin.
E kon tell mi, “Man pikin, yu bilive sey dis bones fit turn to human being again?” I kon ansa, “God wey get pawa, na only Yu fit ansa dat kind kweshon!”
Den Nikodimos ask am, “How dem go fit take born pesin wey don old for di sekond time? Abi di pesin go enter en mama belle make di mama born am again? E fit happen like dat?”