Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 15:32 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

32 If resureshon nor dey, wetin kon bi my gain, afta I don fight wiked animal for Efesus? Na bikos of pride make mi do am? If na so, e go good make wi dey chop and drink bikos tumoro wi go die.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 15:32
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Or to ask God sey, ‘Wetin I go gain if I nor sin? Any nid dey to live klean life?’


So I konklude for my heart sey, “I just get klean heart for nor-tin! I just dey innocent and nor dey do bad tins for no rizin!


Yong man, make yu happy as yu dey yong! Make yu enjoy evry minute for dis life and do evritin wey yu won do; but remember sey yu go tell God evritin wey yu dey do.


So I kon sey, nor-tin dey good dan for pesin to chop, drink and enjoy di work wey e dey do, bikos all dis enjoyment kom from God.


But instead, una bigin laf and dey do party. Una sey, “Make dem kill sheep and melu make wi chop and make wi drink plenty wine! Make wi drink and chop, bikos wi go fit die tumoro.”


Dem go sey, ‘Make wi buy some wine and drink as wi like! Tumoro go betta pass today and wi go get evritin wey wi wont!’ ”


Den I go tell mysef, “Yu get plenty food wey go last yu for many years, so make yu go sleep, chop and drink, dey enjoy yorsef!” ’


Wetin pesin go gain if e get di whole world, but e luz en soul?


Wen dem rish Efesus, Paul leave Priscilla and Akwila for der, but en ensef enter di sinagog go follow di Jew pipol tok.


but e tell dem bye-bye kon sey, “If God wont, I go kom again kon si una.” Den e enter ship from Efesus


For di same time wen Apollos dey Korint, Paul travel pass inside town until e rish Efesus. For der, e meet some disciples


If God nor ponish us for di bad tins wey wi dey do, e mean sey God dey support us? No! So if God ponish us, wi go sey E dey wiked? (Na so some pipol dey tok).


(I dey tok with human being sense, bikos I know sey una dey weak.) Before, una dey give una body like slave to bad tins, but naw, una must use una full body take serve God, so dat una go dey do only wetin God wont.


But I go stay for Efesus until Pentekost go finish,


My brodas and sistas, make I use wetin dey happen evriday for life take make ezample for una: Wen pipol don make agriment, nobody go fit trow di agriment for korna or add anytin join am.


But dis men bi like animal wey nor dey tink; animals wey pipol fit kill anyhow and dem just dey do as dem like. Dis pipol dey tok anyhow and na distroshon go end dia life.


But dis pipol nor undastand wetin dem dey tok and dis na wetin dem suppose to undastand without sey pesin tish dem. As animals nor dey tink before dem do tins, na so dis pipol dey bihave.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ