15 So, if resureshon nor dey, dat mean sey, evritin wey wi don tok about God, na lie, bikos wi sey E raiz Jesus from deat wen E nor raiz am.
and make una nor lie against poor pesin for kourt.
But God kon raiz am up afta E don gi-am pawa to win deat, bikos deat nor get pawa to hold am.
God don raiz dis Jesus Christ up and evribody si am.
I dey prish give Jew and Greek pipol sey make dem turn from sin kom meet and serve God and put dia faith for awa Oga God Jesus Christ.
My pipol and di oga dem for Israel, make una know sey, Jesus Christ wey kom from Nazaret, di pesin wey una kill and God raiz am from deat, naim name make dis man wey una dey si so, well.
With God pawa, di apostles kon dey bear witness sey Jesus Christ wake-up from deat and God favor kon dey show for dia life well-well.
If resureshon nor dey, dat mean sey Christ nor raiz-up from grave.
If resureshon nor dey, na-im bi sey Christ nor raiz-up from deat.
But God don raiz Christ from deat! And E make us dey sure sey, oda pipol go raiz-up from deat too.