12 Naw, if wi dey prish sey God raiz Jesus from deat, wetin make some pipol among una dey sey resureshon nor dey?
Wen di pipol hear sey pipol go raiz from deat, some kon dey laf, but odas sey, “Yu go tell us dis matter again.”
(Bikos Sadusi pipol bilive sey pipol wey don die, nor go wake again and dem nor bilive sey anytin like angel or spirit dey sef, but Farisee pipol bilive all dis tins.)
Why una tink sey God nor fit raiz pipol wey don die?
But e nor mean anytin if I prish or dem prish, as long as all of una bilive di message wey wi dey prish.
go enkourage and give una pawa for all di good work wey una dey do or di words wey una dey tok.
Dem leave di trut kon dey sey resureshon don happen already and like dis, dem don make some pipol fall from di faith.