8 If trumpet make sound wey pipol nor undastand, who go dey ready to go fight war?
Wen dat day rish, dem go blow one loud trumpet, den Israel pipol wey dem katch go Egypt and Assyria go kom back kon woship Oga God for en holy mountin for Jerusalem.
Den I sey, “I nor go fit bear dis pain! My heart dey beat fast-fast! I nor fit kwayet, bikos I hear di trumpets and war nois.
Make yu blow di trumpet, so dat dem go hear am for Zion wey bi God holy hill. Make evribody fear well-well, bikos God day dey kom.
Pipol nor dey fear, if dem blow war trumpet for di town? Abi wahala dey just happen for town, wen God nor allow am?
If una go fight against enemy wey dey attack una, den una must blow di alarm and di trumpet. Mi wey bi God go kon help and save una from una enemies.
If all music instrument get di same sound, how una go take know di one wey bi trumpet or harp?