Dem bi like shidren wey sidan for market dey tell each oda, “ ‘Wi play music for una, but una nor gri dance; wi sing beri song for una, but una nor gri kry.’
My brodas and sistas, wetin una go gain if wen I kom, I dey tok with difren language wey una nor undastand and I nor esplain am? How I go fit help una den, unless I tell una wetin God tell mi or make una know wetin dem profesai and tish?
“Den yu go-go God hill for Gibeah where Filistia pipol ofisas dey. Wen yu enter di town, yu go meet some profets wey dey kom down from di altar for di hill. Dem go karry harps, sheke-sheke, wiso and lyres and dem go dey tok about wetin go happen.