Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 14:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 Two or three pesin fit profesai and evry oda pesin must listin well-well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 14:29
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dis na di profets and tishas wey dey di church for Antiok: Banabas, Simeon wey dem dey koll Naija, Lucius wey kom from Sirene, Manaen (wey bi Herod di Tetrak friend from small pikin) and Saul.


Di Spirit dey give odas di pawa to do mirakle and e make some pipol profets and some dey fit know wen God Spirit dey among us. Odas dey tok with difren-difren language and some among us go tell una wetin di tins wey dem dey tok, mean.


if I dey profesai and fit undastand evry sekret and knowledge or if I get faith wey fit move mountins and I nor love oda pipol, I go bi nor-tin.


If nobody dey wey go fit esplain wetin yu dey tok, make yu nor tok at-all for di meetin, but yu fit tok am between yu and God.


And if one among di pipol wey sidan receive message from God, di pesin wey dey tish must stop make di pesin for tok.


Pesin wey bi profet must dey ready to stop, so dat anoda pesin go tok, bikos profet suppose to fit kontrol en own spirit,


If una dey tink of unasef as profet or pesin wey di Spirit dey use, den una go know sey I dey rite only di tins wey God kommand mi.


My friends, make una dey try to profesai and make una nor stop anybody wey dey tok with difren-difren language even doh odas nor undastand wetin e dey tok.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ