28 If nobody dey wey go fit esplain wetin yu dey tok, make yu nor tok at-all for di meetin, but yu fit tok am between yu and God.
Wen una dey togeda, make e nor pass two or three pipol wey go tok with difren-difren language wey pipol nor undastand. One pesin go tok, before anoda and make pesin dey, wey go esplain give odas wetin di pesin dey tok.
Two or three pesin fit profesai and evry oda pesin must listin well-well.
Make una test evritin kon dey do wetin good.