Bikos if una dey tok with difren-difren language wey odas nor undastand, God go undastand wetin una dey tok, aldo know oda pesin go know wetin e mean. Tins wey una go dey tok about, na only di Spirit go fit undastand dem.
I for like make all of una dey tok with difren language, but I wont make una dey profesai. Bikos profesy go do una more good, dan sey una dey tok with difren language wey pipol nor fit undastand, unless somebody esplain di meaning give di pipol for di church.
Wetin make una tink sey, una betta pass anoda pesin? Nor bi God give una evritin? So wetin make una dey boast wen e bi sey evritin wey una get, na God give una?