Wen di pipol wey dey stay der si sey di snake put e mout for Paul hand, dem kon dey tell demsef, “E bi like sey dis man hand nor klean! Even doh e nor die inside sea, hand don still tosh am for here!”
God word sey: “I go use strenjas wey dey speak wetin odas nor undastand, take tok to my pipol. Dem go tok to dem with strenj language, but my pipol nor go listin to mi.”
For heaven, e nor get anytin like Greek or Jew pesin; pesin wey dem sekonsaiz or not; bush pesin; pipol wey dey chop human being; slave or free pesin, but na Christ bi all and e dey inside all of us.