Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 13:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Naw, wi nor know evritin and awa profesy nor komplete.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 13:9
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But all dis na small tin kompare to di pawa wey E get. Na small wi don hear. Who go fit really undastand how God strong and great rish?”


Di tins wey Yu know, too dey wonderful for mi; dem too big for mi to undastand!


My Oga God, Yu don do wonderful tins for us. Wetin Yu plan for us too many to kount. Nobody bi like Yu. If I start to kount all di wonderful tins wey Yu don do, I nor go fit kount dem finish.


Who don go heaven kom back? Who don ever katch breeze for en hand or wrap wota for klot? Who kreate di whole world? Na who e bi and na wetin bi en pikin name? Make yu tell mi, if yu know!


“My Papa put evritin for my hand. Nobody know di pikin, but na only en Papa know am. Nobody know di Papa, but na only di pikin and anybody wey di pikin choose to show.


Na who know wetin dey God mind? Who go fit advise God?


But one day, wetin dey pafet go kom and wetin nor dey pafet, go vanish.


Evritin wey wi dey si naw bi like ordinary image for mirror; but for dat time, wi go si am, face-to-face. Naw wi nor know evritin, but den wi go know, just as God really know us.


But God word sey, “No eye don ever si; no ear don hear, even pesin mind nor fit tink about di tins wey God don prepare for pipol wey love am.”


Di man wey tink sey e know sometin, neva still know as e suppose know.


Na mi small pass for all God pipol, but God don give mi grace to prish di Good News give Gentile pipol and dis grace wey Christ give mi, nor dey finish.


My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ