Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 13:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 If I give pipol evritin wey I get kon sey make dem burn mi alive, but I nor love odas, I nor go gain anytin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 13:3
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Una tink sey wetin una dey do dey rite, but I go disgrace una and una juju nor go fit help una.


“But make una si una life! Una dey bilive lie-lie words wey nor go save una.


“All wetin dem dey do, na make pipol for si dem. Dem dey tie tins wey dem rite God word put for dia fore head and hand, so dat pipol go si dem.


Wen Jesus hear wetin di man tok, e kon tell am, “E still get one tin wey yu neva do, make yu sell evritin wey yu get, give di money to poor pipol, den yu go get betta propaty for heaven. Afta dat, make yu kom follow mi.”


Den Pita sey, “Oga God, wi don leave evritin wey wi get kon follow yu!”


But Zakius stop kon tell Jesus, “Oga God si, I go give half of wetin I get to poor pipol and evribody wey I don shit before, I go pay am back four times!”


Bikos Jew pipol like make pipol dey praiz dem pass wetin God tink about dem.


Pita ask am, “Oga God, why wi nor go fit follow yu naw? I ready to die bikos of yu!”


E nor get love wey big rish di one wey make pesin die for en friend.


Na di Spirit go fit give pesin life; human being pawa nor fit do am. All dis word wey I dey tell una so, dem bi Spirit and dem dey give pesin life.


But Paul ansa, “Wetin una dey do so, una dey kry dey won break my heart? I ready, nor bi only make dem tie mi, but to die for Jerusalem, bikos of Jesus Christ name.”


Make wi nor dey karry body up and dey do wetin go vex pipol or dey jealous one anoda.


Make una nor dey karry body up, but make una trit each oda like unasef. Instead, una dey do wetin una like, bikos of di tins wey una go gain, so dat una go fit boast.


Fisical trainin dey good, but na to know God good pass, bikos yu go get reward for dis life and di one wey dey kom.


Make una nor let difren-difren prishin wey una nor know turn una head. Una spiritual pawa dey kom from God grace, nor bi from food wey dem sakrifice, bikos di sakrifice nor fit help pipol wey dey do am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ