Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 13:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Evritin wey wi dey si naw bi like ordinary image for mirror; but for dat time, wi go si am, face-to-face. Naw wi nor know evritin, but den wi go know, just as God really know us.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 13:12
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Jakob koll di place Penuel, kon sey, “I don si God face-to-face and I still dey alive.”


Even wen sickness don chop my skin, as I still dey dis body, I go si God.


“Wi nor fit know how God strong rish. Wi nor fit search or kount how many years God don dey.


God go tok to Moses face-to-face, just as man dey tok to en friend. Den Moses go-go back to di kamp; but en yong savant Joshua wey bi Nun son, nor go komot from di tent.


“Man pikin, go tell Israel pipol dis parabol;


So I go tok with am face-to-face and nor bi with word wey e nor go undastand and e go si as God bi. So wetin make una nor dey fear to tok against my savant Moses?”


“Make sure sey una nor porshu any of dis small shidren komot. I tell una di trut, dia angels dey my Papa front for heaven evritime.


God go bless una wey get pure heart, na una go si God.


Bikos my Papa know mi and I know am, naim make mi ready to die for di sheep.


I dey sure sey, wi nor go fit kompare all di sofa wey wi dey sofa naw, with di glory wey God go give us.


Wen wi neva know Christ, wi dey tink and tok like small shidren. But naw wen wi don know am, wi nor dey do like small shidren again.


All of us wey don bilive Christ, God glory dey show for awa face. So di Spirit dey help us shange, so dat wi go bi like Christ.


bikos wi dey live awa life with faith, nor bi with wetin wi dey si.


Nor bi sey I don get evritin wey I wont or God don make mi pafet, but I dey try make I get di prize wey dey kom from God kon hold am as Jesus Christ whole mi.


Pesin wey hear God word and e nor dey do wetin e tok, bi like pesin wey dey look en face for mirror.


My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi.


Dem go si en face and en name go dey dia fore head.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ