4 Na many spiritual gifts God dey give pipol, but all of dem na from di same Spirit.
I don put my Spirit inside am, so dat e go know how to do difren work.
My friends, una bin ask mi about spiritual gifts.
So for di church, God first choose apostles, before profets and tishas. E still choose some wey dey do mirakle, odas wey dey heal sick pipol, some wey bi leaders and odas wey dey tok with difren-difren language.
And wi get difren ways to serve God
How I wish sey all of una bi like mi. But di gift wey God give us nor bi di same.
Na Christ make some among us bi apostles, profets, evangelist, pastors and tishas.
God use signs, mirakles and wetin di Holy Spirit do, take show sey, dia words na true.
God don give evribody en own gift, so make una use di gift take help each oda as good savant wey get God grace.