26 If one part dey sofa, di oda parts dey sofa too. But if dem praiz one part, di oda parts go dey happy.
Jesus ansa, “Make e bi so naw, e betta make wi do evritin wey God wont.” So, John kon baptize am.
If yor rite eye go make yu sin, make yu plok am komot. E betta sey one part for yor body nor dey, dan sey all yor body enter hell-fire.
Wen pipol dey happy, make una follow dem happy and wen dem dey kry, make una follow dem kry too.
God do am like dis, so dat all di parts for di body go dey work togeda and each part go dey kare for oda part.
All of una dey Christ body. And each of una, na part for di body.
Make una help karry each oda load and if una do like dis, una dey obey Christ.
Make una remember doz wey dey prison, like sey unasef dey der with dem and make una remember doz wey dey sofa, like sey una dey sofa like dem.
So, make una live for peace togeda, dey sorry for each oda; love one anoda and nor dey karry body up.