22 So, wi nor go fit do anytin with awa body without di part wey wi feel sey, e dey weak.
Di king glory na wen en pipol dey plenty more-more; but prince wey nor get savants, nor get anytin.
Na evribody dey enjoy wetin di land dey produce; even king dey put hope for wetin dem harvest from farm.
So, di eye nor go fit tell di hand sey, “I nor nid yu” and di head nor go fit tell di leg sey, “I nor nid yu too.”
Di part wey wi tink sey dey important, wi dey trit dem with respet and di part wey nor really dey outside, wi dey trit dem well.
As una don join dey pray for us, na so too God go ansa all di many prayers wey una dey pray for us, den E go bless us and many pipol go kon tank am, bikos of wetin E dey do for us.