Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 12:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 But God don put evry part for awa body, just as E wont am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 12:18
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen yu go war, yor pipol go dey happy to follow yu go fight. Na holy garment dem wear for yor body and yor pawa go dey fresh evriday like morning dew.


E dey do anytin wey E like for heaven and eart, both for under di sea and ocean too.


I know di end from di biginnin and na from wen I kreate di world I don dey tok tins before dem happen. I sey na as I plan am, na so e go bi and I go do am as I wont am.


So dem kry to God sey, “God wey get pawa, wi beg, make Yu know let us die, bikos of dis man! Make Yu know ponish us sey wi kill dis innocent man, bikos Yu wey bi Oga God, must do wetin Yu wont.”


For dat time, di Holy Spirit kon make Jesus dey happy, so e kon sey, “I praiz yu, Papa wey bi Oga God for heaven and eart, bikos yu don hide dis tins from pipol wey get sense and wise, but yu show dem to yor shidren. Yes, Papa, na so yu wont make e bi.


“Make una nor fear, una wey bi small sheep, bikos una Papa go happy to give una di kingdom.


By di grace wey God give mi, I dey tell all of una, make una nor tink sey una too dey important. Instead, make una use good sense tink and undastand di faith wey God give una.


True God grace, E don give us difren-difren gift to use. If wi dey profesai, make wi do am akordin to di faith wey wi get.


But na di same Spirit dey do all dis tins and e dey choose di kind gift wey e wont give each pesin.


If to sey di whole body na eye, wi nor for fit hear anytin and if to sey all di body na ear, wi nor for fit smell anytin.


If na only one part dey di body, den di body nor go bi as e suppose bi again.


But awa body nor nid all dis treatment. Bikos na God make awa body, so di part wey wi fit sey nor dey important, dey important well-well.


So for di church, God first choose apostles, before profets and tishas. E still choose some wey dey do mirakle, odas wey dey heal sick pipol, some wey bi leaders and odas wey dey tok with difren-difren language.


Dis na bikos God dey give dem di kind body wey E wont make di plant get.


Mi and Apollos na God savant and E use us take prish to una make una for fit bilive, so mi and am dey do di work wey God sey make wi do.


Before, God don already decide thru Jesus Christ sey, wi go bi en shidren, bikos na so E wont am.


E do like dis wen E show us di sekret plan wey E get and di good mind wey E show evribody, thru Christ.


“Awa Oga and God! Yu dey worthy to receive glory, honor and pawa, bikos na yu kreate evritin as yu wont.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ