17 If to sey di whole body na eye, wi nor for fit hear anytin and if to sey all di body na ear, wi nor for fit smell anytin.
Una tink sey di Pesin wey make una ear nor dey hear word? Abi di Pesin wey make una eye nor dey si?
Na God give us eyes to si tins and ear to hear word.
And if di ear sey, “I nor bi eye, so I nor bi part for di body.” Nor bi di body di ear still dey?
But God don put evry part for awa body, just as E wont am.
So, di eye nor go fit tell di hand sey, “I nor nid yu” and di head nor go fit tell di leg sey, “I nor nid yu too.”
Nor bi evribody bi apostle. Nor bi evribody bi tisha. Nor bi evribody fit do mirakle.
(For dat time for Israel, if anybody won go hear from God, e go sey, “Kom make wi go si di pesin wey dey si vishon.” Bikos dat time, dem dey koll profet, “Pesin wey dey si vishon.”)