14 Nor bi only one part awa body get, but dem many.
Christ body get difren part like evry oda body.
If di leg for awa body sey, “I nor bi hand, so I nor bi part for di body.” Nor bi di body di leg still dey?
If na only one part dey di body, den di body nor go bi as e suppose bi again.
But as e bi so, na many parts dey make one body.
Since una don stop to lie, make una start to tok trut give una neighbour, bikos all of us na membas for Christ body.