Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 12:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 But na di same Spirit dey do all dis tins and e dey choose di kind gift wey e wont give each pesin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 12:11
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu nor fit kompare God with anybody for dis world. E dey do wetin E like with di angels for heaven and pipol for dis world. Nobody fit shalenge or ask am, “Wetin Yu tink sey Yu dey do?”


Abi I nor fit use wetin bi my own as I like? Or yu dey jealous bikos I dey do good tin?’


John ansa dem, “Nobody go fit get anytin unless God wey dey heaven, gi-am.


Wen breeze dey blow, e dey go anywhere e wont, yu dey hear di sound wey e dey make, but yu nor fit know where e dey kom from or where e dey go. Na so e bi with evribody wey God Spirit born.”


As di Papa get pawa to take wake pesin wey don die, na so too di pikin get pawa to give life to anybody wey en won give.


True God grace, E don give us difren-difren gift to use. If wi dey profesai, make wi do am akordin to di faith wey wi get.


So, God dey sorry for who E won sorry for and dey ponish who E won ponish.


But God don put evry part for awa body, just as E wont am.


Na many spiritual gifts God dey give pipol, but all of dem na from di same Spirit.


and each of us dey do difren tins. But na di same God dey work for awa life and E dey help us do evritin.


For evry church, I dey tell di pipol sey make dem remain as dem bi wen Oga God Jesus choose and koll dem to bi en own. Naw, na di same tin I dey tell una so.


How I wish sey all of una bi like mi. But di gift wey God give us nor bi di same.


But wi nor go boast pass as wi suppose boast; wi go boast akordin to di work wey God give us and una dey inside dat work too.


All tins dey happen as God wont am and thru Christ, E choose us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di time wen E kreate di world,


But God don give grace to all of us akordin to how Christ gift plenty rish.


God use signs, mirakles and wetin di Holy Spirit do, take show sey, dia words na true.


As God wont am, E kon born us with di true message, so dat wi go bi first among all wetin E kreate.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ