28 So make evribody shek ensef, before e chop di bread and drink from di cup.
Instead, make wi shek and test di tins wey wi dey do kon turn from sin kom meet God.
Naw dis na wetin Oga God wey get pawa dey tok: “Make una tink about wetin dey happen to una!
“God wey get pawa sey, ‘Make una tink about wetin dey happen to una naw.’
Wetin e tok kon worry dem well-well, so dem kon bigin ask am, “Oga God, na mi?”
But if una nor undastand sey na una bi Christ body, una don already kondemn unasef with di way wey una dey chop and drink from di cup.
But if wi judge awasef, God nor go ponish us.
Make una test unasef to know weda una still dey inside di faith; e good make una shek unasef well-well! Una nor know sey Christ dey inside una? May bi una don fail di test!
Instead of una to dey kompare unasef with anoda pesin, make una shek unasef, den una go fit tok about unasef.