Make yu put di two stones for di priest garment shoulder, so dat e go stand for Israel sons and Aaron go karry dia name go meet God, just to dey always remind am about dem.
Draw mi follow yu! Make wi kwik komot here! Make di king take mi go en room. Awa king, wi dey happy well-well, bikos of yu and wi like yor love pass wine. Yes, di yong wimen dey honor yu and dat na di rite tin to do.
I don enter my gardin, my treasure and wife to bi! I don gada myrrh with spices and I don chop my honi-komb and my honey; I don drink my wine and my milk! Una wey sabi love, make una chop and drink until love shark una.
For Mount Zion, God wey dey lead heaven sojas go do big party for all di pipol for di world. For di party, plenty food go dey to chop and wine go dey to drink; betta meat and sweet wine go dey too.
Afta dem chop finish, Jesus take di cup kon sey, “Dis na my blood wey God take make new kovenant with una. Make una always dey drink am to remember mi.”
den make una tell dem how Jordan River take stop to rush, bikos of God Kovenant Box. Wen di box cross Jordan River, di wota stop to rush. Dis stones go make Israel pipol dey always remember wetin happen.”