Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 11:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 I dey praiz una, bikos una always dey do di tins wey I tell una,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 11:2
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem dey do wetin God like, dey follow all di tins wey God tok for en word.


Di way una dey woship God, dey kause wahala pass di good wey E dey do for una. Bikos of dis, I nor go fit praiz una.


Una nor get house wey una go for chop and drink? Abi una hate God church? Una won disgrace pipol wey nor get anytin to chop? Wetin I go fit tell una naw? I nor go fit praiz una at-all.


di one wey una asept and dey stand on. Na dis gospel go save una if una whole di message wey I prish give una well-well, unless una faith nor strong.


Na to enkourage una make mi send Timoti, my son wey I like and wey love Christ kom meet una. E go tell una how I dey follow Christ and di tins wey I dey prish about Christ for evry church.


For evry church, I dey tell di pipol sey make dem remain as dem bi wen Oga God Jesus choose and koll dem to bi en own. Naw, na di same tin I dey tell una so.


So, una kon bigin do as wi and Christ dey do; even doh una sofa well-well, una receive di message with joy wey di Holy Spirit dey give.


But naw, Timoti don kom meet us afta e si una and e tell us di Good News about di faith and love wey una get. E still tell us sey, una dey always remember and dey hongry to si us, just as wi dey hongry to si una.


So, my brodas and sistas, make una stand well for groun kon whole wetin wi tish una tait; weda na thru di words wey wi tok or letas wey wi rite.


My brodas and sistas, wi dey kommand una with awa Oga God Jesus Christ name sey, make una nor follow bilivers wey dey do anyhow and nor dey do as wi tell dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ