18 Bikos I hear sey wen una gada dey woship God for church, na so-so kworel una dey kworel and I bilive sey some for wetin I hear, na true.
bikos una neva get di Spirit since jealousy and kworel still dey among una. Dis mean sey una neva get di Spirit and una still dey live like pipol wey dey di world.
I don dey hear bad-bad tins about some of una. And una own even worse pass wetin doz wey nor know God dey do. Sotey man dey sleep with en papa wife.
Wen pesin nor dey gri with anoda pesin, una dey take una kase go kourt where sinnas go judge di matter, abi una dey take am go meet God pipol?